Nigeria has ban crypto currency exchange
Nigeria Central Bank don memo wey remind pipo say dem don wash hand comot for cryptocurrency and anything wey gatz do wit virtual payment and say make all financial institutions stop dey use am for exchange still dey make pipo tok.
CBN believe say crypto no dey regulated and pipo dey use am do bad tins like money laundering and to sponsor terrorism.
Even though Nigeria no be di only kontri wey dey look crypto with side eye, some celebrities around di world for years now don show support to cryptocurrency as maybe di future currency of di world.
Dis na some billionaires and celebrities wey don show support for crytocurrency
- Bill Gates
Di founder of Microsoft na one di richest pipo for di world and pesin wey like to dey invest well-well. For inside one interview e do for 2014, he say Bitcoin beta pass currency as you no need to dey physically present to make transactions and e dey occur for transactions wey involve large money.
This comment has been removed by the author.
ReplyDelete